Close

Locals rush one South African town to dig for ‘gold’ afta tori say e dey one land

logo

logo

Di digging don damage di land, local authorities tok

Plenty pipo gada dey dig up one property for di Gugulethu informal settlement, wey dey for di city of Springs, Ekurhuleni municipality for South Africa, as dem hear say gold dey for di land.

Dozens of di locals carry dia axes and shovels dey pack sand into sacks wey dem go carry to dia houses to seive am in search of gold.

Tori be say di whole tin start afta one man wey dey dig fence-post bin notice say di soil texture dey unusual and e come test am for water come claim say e find gold.

Even though di claim neva dey verified, di tori bin spread on top social media and witin days, plenty pipo don crowd for di field, wey be somebody private property and start to dey dig hoping to find gold; some even claim say dem find.

Some locals don claim say dem find something, but all di claims never dey verified.

Trending:  Kennedy Center to close for two years for renovations, Trump says

Princess Thoko Mlangeni wey be security guard tell AFP tori pipo say di crowd bin first start to appear on February eight and bifor you know am, dem “spread like a virus”.

She tok say she follow dig but she “only find a tiny little bit”, so she abandon am to face her 12-hour shift job.

According to local tori pipo, di tok-tok pesin for Ekurhuleni municipality, Phakamile Mbengashe, don warn di pipo say di illegal digging dey damage di environment and national economy.

E tok say govment neva even verify di claim to know weda true-true gold dey exist for di site.

Meanwhile, di authorities for di municipality dis Tuesday don warn residents say wetin dem dey do amount to mining without licence and na offence for law.

Mbengashe, di tok-tok pesin for di municipality, tell tori pipo say dem go do quick to clean up di area and restore di land to how e bin dey, but dem go also do more investigation and take action against anybody wey break di law.

Trending:  GES 2024 graduate recruits commend Multimedia for sustained coverage of recruitment challenges

“We don dey gada intelligence for di area, bicos, more dan just cleaning up di place, we need to know wia dem dey sell di gold and who be di buyers, so dat we go stop dis operation and e no go eva hapun again,” e tok.

Di mineral resources and energy department for South Africa don also release press statement wia dem warn say, “any mining activity conducted witout di required permits or mining rights, as prescribed by di Mineral and Petroleum Resources Development Act, dey unlawful and constitute criminal offence”.

“Unregulated excavation fit result in ground instability, placing nearby communities and particularly children at significant risk of injury or loss of life,” di statement tok.

Dis no be di first time sometin like dis dey hapun for South Africa wia di unemployment rate dey as high as high as ova 30 percent.

For June 2021, more dan one thousand pipo bin rush to di village of KwaHlathi for KwaZulu-Natal province to search for diamonds, afta dem discover one kind shining stones for di area.

Trending:  'Difficult to convince my sons to play for Ghana' – CK Akonnor

However, experts later confirm say di stones no be diamond but na quartz crystals wey not too get value.


Local authorities don warn di diggers say to mine witout license na criminal offence, but some still dey dig


For 2021, pipo bin also rush to one village wia dem tok say diamond full for one land dia, but experts later tok say di shinning stones na ordinary quartz.

Source:
www.ghanaweb.com

scroll to top